CINDERELLA (Pidgin poem)



I don become mumu because of your love,
I don become deaf to haters jealous words,
What if tell you say I don become blind man–
Wey no fit work without you beside me all day

I no sey Jesus na master of doing miracles,
But yours con raise the dead feelings in me.
I no sey Judas betrayed Jesus because of money–
But no money fit buy your love wey dey my heart

See, na famous royal family I take come from
I go take you to go see ma beautiful mama for home,
I promise sey she go welcome you beautifully
With plenty plenty love wey she wear for her face

Cindarella, even if all girls gather because of me
I no go look their side, cus you be my chosen one,
If all witches and wizards gather to separate us,
Dem no fit, cus we don become like covalent bond.

©PORTRAIT

Post a Comment

0 Comments